Friday, March 11, 2016

LAGOS POLICE DON CATCH LEKKI GARDENS OGA FOR THE BUILDING WEY FALL



Lagos State Police say dem don catch the Oga Managing Director for Lekki Gardens, Mr. Richard Nyong on top the 5 storey building under construction for Kushenla Road, Ikate Elegushi, Lagos State, wey fall kpain like 35 pipu. Tori yarn us say na on Thursday dem catch the 34 years old Oga. One of the contractors wey dey handle the project, Odofin Taiwo dem bin don catch am on Wednesday. 


The building fall around dat kain 3am on Tuesday when plenty workers still dey inside. We come still hear say State government bin don close down the building wey no suppose pass 3 storey. Dem say na strong head make Messrs Lekki Worldwide Estate Limited, wey be owners of Lekki Gardens, go Dodge open the property and continue to dey build more Dan wetin government bin approve. Na so the Commissioner for Information and Strategy, Mr. Steve Ayorinde yarn. The Lagos State Police megaphone, Dolapo Badmos don confirm the Mata.

No comments: