Thursday, March 17, 2016

SEE HOW OLD LIL KESH TURN TODAY AS HE DROP HIM ALBUM Y. A. G. I.




Nigerian rapper, Ololade Keshinro wey everybody sabi as Lil Kesh dey do him byday today O,  na today the guy turn 22 years and to come celebrate am,  he don drop him first studio album Y.A.G.I (Young And Getting It) today wey be March 17, 2016. 


He do him album listening party for Industry Nite yesterday before he come Waka go Club Rumours for Ikeja , Lagos go celebrate him byday. On top the19-track album he do collabo with pipu Patoranking, Ycee, Phyno, Viktoh, Davido, Adekunle Gold, American rapper, Wale and of course him Oga, Olamide plus many others.

No comments: