The 8th edition for Splash Fm integrity marathon wey shele for Ibadan don come and he don Waka but we suppose let una Sabi say na we brodas from North come carry plenty of the money O. Person wey win for the full race na Iliya Pam all the way from Nasarawa State wey get big number 436 and pipu wey follow am do 2nd, 3rd, 4th come reach 5th na from Nasarawa.
Thank God for the babe wey win for the female, na she be from Southwest and as she finish am, na carry dem carry her go where she go register. Drama still shele when one babe do Ojoro to enter do second female, thank God say dem monitor the thing wella, na so dem take fall her hand say no be so, na Ojoro she wan do. But the marathon make senses sha.
No comments:
Post a Comment