Tuesday, March 22, 2016

SEE HOW POLICE TAKE CATCH 26 YEARS OLD MAN WEY THIEF 7 MONTH PIKIN



Lagos police don catch 26 year old Happniess Umaru sake of say he thief one 7 month old baby for the Ijora area of Lagos state on March 16th. Tori yarn us say na some police officers wey dey patrol Eric Moore road Surulere see am catch. When dem ask question, Umaru first lie for dem say na him born the boy but after hand touch am well he lie say na pick him pick the boy for one bush wey dey inside Ijora Railway when he go do major toilet mata. 

When police come follow am go where he say he for pick the pikin, dem see the pikin Mama, Patricia Victor wey say she don dey find the pikin tey tey, she say she put the baby for bed inside house around dat kain 8 for night to go buy for for her pikin, by the time she go show back,  baby don disappear. She say she shout so tey,  neighbors come join her find the pikin all through the night, but dem no see am. Police say dem go soon show Umaru face for court on top say he thief pikin.

No comments: