MISS SIMPLICITY - Psquare mata don dey wan tire their fans sake of sey dem no expect all this their fight. Yestaday Peter Okoye tok sey make him Broda no let pipu dey see ham as bad pikin nd he tok sey make dem no dey give media wetin dem go eat nd he still com tok sey Jude nd Paul bin gang up against ham, now Jude Okoye don reply o, he tok sey d tori wey dey so, get 3 sides nd if dem open d 3 sides, d truth wey dey dia no fine at all oo.
Paul sef don para delete d apology message wey him bin send give Peter. Hmmmm abegi make una go settle dis tin jor, no be one blood dey flow for una vein?? Abi una own blood no thick pas water? Na to settle sure pas abeg bcos na everybody like Psquare..Abeg ooooo
No comments:
Post a Comment