MISS SIMPLICITY - Olaide Olaogun na one actress wey make sense die, na she win d face of Lux for 2007 afta Genevieve Nnaji drop ham nd na she be Lux ambassador for 2007-2008. Olaide marry Babatunde Ojora for Dec. 3 2015 for d Summit Hall wey dey Ikeja nd na many of her colleagues naim wear aso ebi dat day.
Now d actress don get belle nd as e be so, e be like sey she no go tey born, so her frds com host baby shower for her nd dem spend money for d tin bcos d pictures wey dem snap dey smell money..Lol bt her fans com dey look sey e wan be like sey na twins she dey expect o sake of sey na both pink nd blue colour teddy dem use take play for d baby shower o. Anyway we for TPN dey follow u pray give Baba God sey make Him make d day wey u go born easy for u ooooo. Congratulobia Ma'am.
No comments:
Post a Comment