Naija Musician, Olumuyiwa Osinuga wey everybody sabi as Nomoreloss don kpain today for Lagos. Tori yarn us say dem carry her go hospital 2 weeks ago afta dem say he get typhoid and dem bin don free am, wey he don dey well before the thing hit am again dis morning, March 21, 2016 wey come kill am.
NET say dem Halla him manager, Joice Ize Iyamu who confirm say na true the bros don cross Jordan. She say na for him house for Lagos death for catch am. Na for Lagos dem born am in the 70s, Nomoreloss go A.D.R.A.O. International school for Victoria Island for him primary and secondary education. And na Kunle Ajayi teach am how to play saxophone when he see day he like music. Na this Bros stand for front dey gbege many celebs when dem dey do ‘Save OJB campaign’ when OJB Jezreel bin get kidney palava in 2013. Some of him popular songs na ‘Iyawo Asiko’, ‘Oro Re’, ‘Ololufe’ plus others. We for TPN pray make God give am beta sleep and make he be with him family.
No comments:
Post a Comment