Wednesday, March 23, 2016

OYA NA... SEE WHY IPOB SAY MAKE NDIGBO NO CHOP FULANI COW AGAIN



This mata dey funny me one kain,  even e no be joking something. IPOB, don polongo say make all  Igbo pipu stop to dey buy dey chop Fulani malu,  so the Fulani pipu no go fit take style enter dem towns and villages come do dem strong thing, dey kain dem, dey rape dem women. 

IPOB even ask Ndigbo make dem start to dey from dem own cows wey plenty wella for Abuja liking wey dey Ebonyi State, Nsukka for Enugu State plus Obudu wey dey Cross River State. Na so dem talk for one statement wey dem sign by IPOB’s Media and Publicity Secretary, Comrade Emma Powerful.

No comments: