Wednesday, March 23, 2016

NAWA O... SEE WETIN MAKE JUSTICE KAFARATI COMMOT HARD FOR SARAKI CASE



Justice Abdul Kafarati for the Federal High Court, Abuja, don commot him hand  from the fundamental rights mata wey Senate Presido Bukola Saraki carry go him court say make he throway the gbege wey dey him neck say he lie when he dey polongo him property wey federal government dey follow am drag for the Code of Conduct Tribunal (CCT). 


For the mata yesterday, March 22nd, Justice Kafarati say wetin make am commot him hand na wetin one online media site, Sahara Reporters write about am say him, Kafarati, dey corrupt and Saraki don carry money settle am. Kamara say him integrity din dey shake,  so he no dey do again,  he don carry the case file back to Chief Justice make he Fina anoda Judge carry am give.

No comments: