Ondo state House of Assembly don change beat for dem Speaker Jumoke Akindele, wey dem bin chase plus her deputy Fatai Olotu. Na so Olamide George wey be chairmo for the House Committee on Information yarn when he dey do press conference for Akure, DE. state capital, on Wednesday.
He say dem do one kain meeting before Wednesday 9th of March, 2016, and na for there dem decide say make dem allow the madam continue as dem speaker. George say the house still stand together and nothing dey shake dem. But tori dey circulate say na dem Governor follow dem don meeting wey make dem calm down.
No comments:
Post a Comment