Tuesday, March 22, 2016

ON TOP WETIN... SEE HOW DEM KPAIN CORPER FOR RIVERS ELECTION




NYSC don polongo say one corper, Okonta Samuel wey get call-up number call-up number RV/15B/5539 don kpain when dem dey do election again for Rivers State wey shele last weekend. 

Na one statement by dem NYSC Oga talk say Samuel bin dey serve for GCSS Ukpeliede, and na pipu wey dey carry gun wey nobody sabi shoot am die for Ahoada West Local Government Area on Saturday March 19th. Tori still yarn us say the guy no get Papa and Mama O,  but dem promise to make sure say pipu wey kpain am no go without say dem collect beta punishment.

No comments: