Na which kain winsh be dis na... E no reach 24 hours afta we Presido, Buhari polongo say dem don open the international conference on peace and stability for Abuja, na so we hear say thieves don thief the handset for one Executive Secretary for the World Muslim League Saudi Arabia, Dr. Abdullahi Bin Abdul.
Dem say the thing make we Security agencies shame cos na dem pipu dey ask plenty question wetin happen and how the phone take miss. Dem say the Baba sef dey worry on top the mata. Tori yarn us say dem give the Baba Bin Abdul beta honour make he lead Jumat prayer for the National Mosque on Friday, and na so security pipu take form circle round am and him pipu. Na afta the Jumat, many pipu try near am and na there den for move the Baba handset. The Baba just dey shout Allahu, say as security plenty reach dem still fit move him phone. Dem say na so Lal of we big Naija pipu wey dey there wan enter ground as shame catch dem no be small.
No comments:
Post a Comment