MISS SIMPLICITY - Mercy Aigbe don para, she don provoke on top d pipu wey "This day magazine" pick as d actors nd actress wey dress pas for d AMVCA wey just pass. Her fans naim bin make Mercy go check d magazine nd she para wey she see d picture.
She don tok sey dem no put her for d list nd d cover bcos dem no wan stain their magazine wit local Yoruba actress, that is to sey she feel sey the magazine see her as local. Una go fear para naw, ma'am Mercy Aigbe abeg no vex, if dem no see u, we see u ooooo nd u make sense die that day...
No comments:
Post a Comment