I talk ma last week say e be like say we don enter baby season for Naija entertainment, as per say na 2 ogbonge entertainer wey still be radio pipu born baby last week. As we never finish the food from all those naming ceremony, na so tori yarn me say one of the best DJ for Naija, wey win award for best radio dull for this last NBMA AWARDS wey shele for tike wey no too tey, Dj Gavpop sef don born on Wednesday last, that is to say na dis Wednesday we dey fall in for baby parry. We for TPN join mouth with millions of pipu all over the world say congratulobia to Bros Gafar Popoola.
No comments:
Post a Comment