Tuesday, March 1, 2016

NAWA O...DEM SHOW 4 SECURITY FOR COURT SAY DEM THIEF THITE

Four security guards wey dem give work make dem dey protect church don thief N500,000 from inside box where dem dey put tithe.Na so dem carry dem on Monday come Tinubu Magistrates’ Court for Lagos State. Tori yarn us say all of dem say na lie dem lie for dem head o, dem no reason bad thing together and dem no thief. Dem name na  Amos Danjuma, 20; Taiwo Akintola, 39; Bright Innocent, 28; and Tajudeen Shoni, 64. Dem say na January 25 dem do the bad thing around dat kain 4am early momo. The money wey dem say dem thief na for Ascension Anglican Church wey dey Alasia bus stop, Badore Road, Eti-Osa, Lagos. Dem sha don free dem on bail.

No comments: