Tuesday, March 1, 2016

DEM SAY MAKE NOBODY GO BANK TODAY FOR NAIJA O!

I pray make e work o, dem don polongo say today wey be March 1, make nobody enter bank for Naija o. Say wetin? Na him dem say make we take do aluta against banks as dem dey chop pipu money anyhow, wey dem dey call bank charges. The Consumer Advocacy Foundation of Nigeria, wet be organization wet no dey for   profit-making na dem polongo some weeks ago say today March 1 na ‘No banking day’. CAFON say dem members go ginger bank customers across the country make dem bone banking services nationwide. The campaign na to force banks make dem stop the nonsense. Na last week, the Central Bank of Nigeria yarn us say money wey banks make from dis yeye charges na like N6.2bn for year 2015, but sha o dem say dem go stand with Naija pipu to stop the yeye charges.

No comments: