Tuesday, March 1, 2016

SMIRNOFF HOUSE PARRY GO LAND FOR IBADAN ON SATURDAY

( EVENT WAKA) Shebi you dey see all those parry wey we dey see for inside music video, wey go be inside house. Dat kain parole na him dey land for Ibadan dis weekend. Na on Saturday, Smirnoff wan sama us dat groove for Ibadan, as per say dem don do am for plenty places all over the world, na him dem say make dem still come do Ibadan o, make cheating for no dey. Dem dey try do am coded say the venue na one kain secret place but tori wey reach TPN say na for one popular hotel around Ikolaba dem wan do am inside the presidential suite. But the show sha na by invitation abi RSVP. Make una softly groove o!

No comments: