Popular Yoruba actress, Taiwo Aromokun don yarn say her marriage to her husband wey dey Holland, Olayemi Abimbola, wey everybody sabi as Ogun of Holland don fall. E neva tey wey she show back Naija from UK with her twins and na for one TV interview, she for talk am like, come still say wetin dey important to her pass for now be how she go take care of her 2 pikins plus concentrate more for her work as she go soon start one kain talk show by May. Na December 26, 2012 she marry Ogun of Holland for the Ikoyi Marriage Registry , Lagos. She come move go U.K. afta the wedding where she for born her twins, Jade and Jamine. Tori yarn us say wetin fall the marriage na when Taiwo see say her guy don first marry Oyinbo and dem don born 2pikins together. Na him make her vex say the guy do am 419.
No comments:
Post a Comment