Thursday, March 17, 2016

NAWA O... SEE WETIN GUNMEN DO TO ANODA PERSON HEAD FOR RIVERS STATE



Nawa O... Head don come turn grass for Nigeria cos dem just dey cut pipu head anyhow these days. One 28 year old guy wey dem call him name Ukeoma,  na him dem don kpain O. If to say dem just kpain am ni,  e for no bad reach say dem come still cut him head commot. 

Tori yarn us say nobody sabi the bad pipu wey do Dat kain bad thing early mom today for Mgbuitanwo wey dey Emohua Clan for Emohua Local Government Area inside Rivers State, wey be the village for APC Senatorial Candidate for the election re-run wey wan shele dis Saturday. For anoda tori,  bad guys wey carry gun do still carry anoda person for the area. And tori yarn us say na the second person wey dem go cut him head be dis for the last 2 weeks for Rivers State

No comments: