Kasala burst last Sunday for Nigeria Professional Football League Week 9 game wey happen between Sunshine Stars and we Shooting Stars for Akure. Tori yarn us say Sunshine Stars flog 3SC 2-1,but no be there e for end O, the koko na how dem fans wey dey vex for wetin nobody sabi flog 3SC General Manager, Rasheed Balogun, plus the team General Coordinator, Abubakar Abubakar wey everybody
sabi as Dan Fulani for the VIP stand for the Ondo State Sports Complex, Akure. Pipu wey dey there say no be small flogging O, as dem hayaj Balogun plus Dan Fulani afta Tope Orelope for 3SC score one goal to make the goal 1-1. Dem say na sharperly dem rush Balogun and Dan Fulani go hospital. Tori yarn us say dem no gree make anybody snap abi record before Okiki Afolabi go score late goal. Oga Balogun say na God save am O, cos he no even Sabi where he dey "It was God that saved me, he say dem collect him money, wrist-watch plus other beta things wey dey him body. Thank God for security pipu wey sharperly calm things down.
No comments:
Post a Comment