Tuesday, March 29, 2016

HMMM... SEE HOW MUCH NAIJA ARMY WAN ROGER ANYBODY WEY GET BETA GIST




Nigerian Army on Monday don polongo say dem ready to sama 1million Naira give anybody wey get beta gist wey fit help dem see dem officer, wey some bad guys kidnap, Col. Samaila Inusa. The Nigerian Army, through dem GOC for One Mechanised Division of the Nigerian Army, Kaduna, Maj. Gen. Adeniyi Oyebade, don first talk on Sunday say 

dem go sama anybody wey get beta information 500k . E no finish for there O,  dem still say dem go protect wella anybody wey yarn dem dat kain beta gist and make sure say nobody sabi who he abi she be. On Monday, the megaphone for the army for One Mechanised Division, Kaduna, Col. Abdul Usman, carry the money go N1m. Oga say all na to make sure say dem free dem person wey dem kidnap. Tori yarn us say Inusa, dey serve with the Nigerian Army School of Infantry, Jaji, near Kaduna State, and na gun dem take kidnap am for Kamazo, along Kaduna Refinery Junction for Chikun Local Government Area of Kaduna State on Saturday night. Dem say na even him Benz dem take carry am before dem drop him wife who be follow am dey for inside car that time.

No comments: