Wednesday, March 23, 2016

LWKMD... SEE HOW MAMA WOLI TAKE KIDNAP STILL 419 ONE MAN FOR LASGIDI



One prophetess, Victoria Okere, wey dey for New Revelation Church, Ogba Oke Ira inside Lagos, na him dem don catch say she kidnap one Wisdom Aworegbe and 419 am take collect N3m, inside one month. Tori yarn us say na policemen from Ikeja divisional police station catch am when the family pipu of the guy go complain give police. 


Aworegbe wan sell one house wey be for him elder sister to Okere, when she do am strong thing. Police dey talk say na kidnap the Mama WOLI kidnap the guy but na later we come see say no be Dat kain kidnap joor,  she just dey use him head ni wey Oyinbo dey call brainwash.

No comments: