Wednesday, March 23, 2016

SEE HOW MANY PIPU DON KPAIN FROM ISIS BOMB FOR BRUSSELS



Number of pipu wey kpain don pass 30 for the 2 bombs wey now yesterday for airport and metro station for Brussels wey be Belgian capital. Tori yarn us say the full country na him dem lock up afta ISIS claim say na dem throw the bombs. Na where pipu wey wan commot from airport dey na him we here say the bomb for blow and na like 230 people woundjure. 


Belga news agency say na gun dem first shoot before the bomb blow wey some pipu come still dey shout for Arabic say na dem dey burst kasala. Na so news agency wey dey follow Isis rob body, AMAQ say na dem fighters do the badt thing, den say na plenty bomb dem pipu take do Brussels strong thing.

No comments: