Monday, March 14, 2016

IBADAN COMEDIANS GO SHAKE LAGOS AGAIN FOR ALI BABA SPONTANEITY



I think say pipu wey no believe suppose don dey believe now say Ibadan na home for plenty beta things. Apart from say many comedians wey dey make brain start dem hustle from Ibadan, pipu like Bash, Seyi Law, Gbenga Adeyinka, Lafup plus others. Last year, na 3 comedians from Ibadan dey the final of Ali Baba Spontaneity, na him be say dem win different for months, wey dem take dey do qualification. In fact person wey do 2nd from the competition na REMOTE, from Ibadan. 
Now dem don start qualifiers for dis year again and Ibadan guys don still go shake dem for LASGIDI. Youngest OAP for Ibadan wey still be Comedian, Anointed Mallam go there go show himself till he reach the final stage,  same for MC Package wey still scatter ground,  so they he don win and him don qualify for the grand finale wey go shele on the 1st of January, 2017. So we say best of luck to him and other pipu wey go still qualify from Ibadan before the year end.


No comments: