Mrs Mary Ayeni wey born twins wey join together for belle don polongo say make pipu help am O afta the hospital where she for born dem for Enugu dey yarn say na dem musto do the operation take separate the pikins O, sake of say dem don do dat kain thing before for the 80's. The pikins Mama dey say make dem just give am the scan sheet plus other medical documents for the pikins so she go fit carry dem go beta hospital where she fit trust with that kain operation, but the hospital no wan hear, dem yari say dem fit after all dem don do am before in 80 something.
No comments:
Post a Comment