Thursday, March 24, 2016

ON TOP WOMAN... 400 LEVELZ STUDENT CHUKE HIM PADI DIE



One 400 level student for Moi University Kenya, Stephen Wairimu na him dem don chuke die by him  schoolmate on top woman mata. Tori yarn us say the person wey do the bad thing, Diskson Syengo na First Year student, and he don high when he take kpain him school Padi. Tori still yarn us say na on top one new student, Faith, wey dey run dem 2 package dem dey fight O. 


Katakata burst wen dem jam for the babe house for Pioneer Estate. As e dey hot,  na so Syengo go carry kitchen knife, take chase the other guy, Stephen Wairimu when he come meet am,  ha chuke am 8 times. The guy come kpain for where dem dey give am treatment for the Moi Teaching plus Referral hospital. Police confirm the level say dem don hold Syengo down for Langas police station where he dey wait for him trial.

No comments: