One undercover investigator for SaharaReporters say he dey wen Saraki’s pipu go meet Judiciary reporters inside one Abuja garden wey dey call Nelson Nuek Gardens, where dem Roger dem N50k each. The garden dey Central Business District for Abuja, and e no too far from. International Conference Center. Sahara Reporters say na all judiciary reporters wey dey cover Saraki case dey the meeting. Dem say Chuks Okocha, wey be special assistant to the Senate Presido na him share the money for the meeting. Dem say na only one person go write the tori wey others go come photocopy come add litu Medenmeden and send am to dem Oga. Tori yarn us say before he become Saraki guy Saraki’s guy, Mr. Okocha bin dey work for Thisday newspaper group, wey Nduka Obaigbena get. Dem say dem no go smile O, if anybody collect dem money come still write nonsense about dem.
No comments:
Post a Comment