Ekiti State Governor Ayodele Fayose don tear for President Muhammadu Buhari on top how some DSS guys go hayaj dem for Ekiti State House of Assembly. The Governor say na Buhari dey behind the mata and he fit vex chase dem DSS from Ekiti State, especially government house plus other government offices. Fayose for one statement by him Special Assistant on Public Communications and New Media, Lere Olayinka say he no go shake come bow for Buhari, say if Buhari like make he carry all DSS men for Naija with dem weapon to Ekiti say dem no fit do nothing.
No comments:
Post a Comment