Monday, March 7, 2016

OWANBE OF LIFE... OONI OF IFE DON READY TO MARRY HIM OLORI

Dem say plans don set finish O as the Arole Oodua, Imperial Majesty, Ooni of Ife Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi don ready to marry Olori Wuraola Otiti Zynab Ogunwusi. Tori yarn us say the wedding invitation plus other details of the wedding don commot. Dem say new olori na from Benin kingdom and she be family of dem Obayuwanas, wey get Polo Nigeria Limited. Na Saturday 12th March 2016 the Mata go shele by 12 noon for the Edo Hotel premises, wey dey No. 4 Okada Drive GRA Benin City, Edo State, the Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, go do traditional wedding things with Otiti Zyna Wuraola. On Sunday, 13th March 2016, dem go come do Thanksgiving ceremony of dem traditional union for the Royal Court of Ife, Aafin, Enuwa Square for Ile-Ife, Osun State by 12 noon. Pipu wey person fit call for more info na John Obayuwana, the Chairmo for Polo Nigeria, plus Ooni of Ife’s sister, Princess Folake Fadairo. Honeymoon go come follow for Obudu Cattle Ranch. Toor.... We for TPN say Happy Married life to Arole Oodua.

No comments: