Wednesday, March 23, 2016

FINALLY... DEM DSS DON RELEASE EKITI STATE HONOURABLE WEY DEM CATCH



DSS don release Afolabi Akanni, the Honorable for Ekiti State Assembly wey dem state government say he don kpain for the dommot of dem DSS. Make we no forget say na on March 17, the Ekiti government burst kamala say the Honorable don kpain bcos he dey sick for dem DSS dommot.  


After dat na him DSS carry the guy come show say na true e dey sick but he neva die. Make we no forget say na on March 4 dem catch am and e keep am till dem release am yesterday.

No comments: