Wednesday, March 23, 2016

ISSOKAY... SEE WETIN DIS GUY DO POLICE WEY MAKE COURT SAY MAKE DEM GO KILL AM



Dem show face of Jackson Feutubobai for Bayelsa State High court yesterday say he kpain one Inspector Joseph Ofozini for Lobia II community wey dey Southern Ijaw Local Government Area of Bayelsa State on April 5th 2013. Jackson na part of one gang wey kpain 11 police officers that year. 


Judge wey siddon on top the mata, Justice M.A. Ayemieye when he dey deliver her judgment, say he dey compulsory make dem go kpain anybody wey do Dat kain thing. When government lawyer, Arthur Andrew Seweniowor dey yarn he say if Jackson no carry the mata go anoda court say he no gree with the judgment in the next 3 months, the state governor, Seriake dickson go sign him death warrant. The badt guy lawyer, Efieseimokumo Bipeledei, don first don beg the court make he please do the guy jeje, say the guy na family man wey get 5 children,  come beg the court say make dem reduce the punishment to prison. 

No comments: