One 34-year-old Naija man don chuke him fellow Naija guy die on top argument of who sabi pass between C. Ronaldo and Lionel Messi. The deceased, Obinna Durumchukwu, dey celebrate him 34th byday on Saturday, with him Padi wey still kpain am Michael Chukwuma (22), Tori yarn us say dem first do parry for dem house wey dem rent for Mahesh building, Ostwal Nagri, Nalasopara (east). Na so dem still groove till 9 am on Sunday, when dem say make dem play football for verhanda. Tori yarn us say dem two don high, na so dem start to dey argue who sabi pass between Ronaldo and Messi. Na so Obinna vex throway empty glass bottle for Michael. Na so Michael Dodge am. Michael come carry vexation take the bottle wey don break chuke him padi for neck wey him come kpain immediately.
No comments:
Post a Comment