Wednesday, March 9, 2016

ARMED ROBBERS HAYAJ FGGC CALABAR, SHOOT 1 TEACHER

Na wa o. Yesterday nite robbers go hayaj dem for the staff quarters for FGGC, Calabar, Cross River State and tori yarn us say dem dey there for plenty hours! Dem even shoot one of dem teachers Mr T.B Samson. According to reports, the robbers Tori yarn us say the robbers enter for the side wey fence no dey,  na there dem pass enter kitchen come enter the house. Wetin come make the Mata funny one kain na say the school no far at all from the head office of the DSS.  Samson say the robbers dey shot anyhow take create awareness but the DSS pipu just lekwe for dem dommot no come out. Samson say dem rush am immediately go Airport Police Division go complain but police say make dem dey go cos dem no get motor to take work.

No comments: