Wednesday, February 17, 2016

YOU NO FIT STOP NEW OLUBADAN MATA, COURT CLEAR SERIKI FAMILY


One State High Court on Tuesday don throway the Mata wey Strike family carry come make dem take stop coronation party of Chief Saliu Adetunji wey go make am become the new Olubadan of Ibadanland. Chief Adebayo Oyedeji wey be the Oga for dem Seriki family dey claim say na him suppose be the new Olubadan after the former Oba,  Oba Samuel Odulana Odugade don go join him papa's dem. Dem carry the Mata go court as dem don polongo say na Adetunji go be the new Olubadan, say make court no gree make dem crown am O,  till dem finish the Mata wey dey court. Dem even dey argue say e no make sense as the Olubadan Chieftaincy family plus the Balogun Chieftaincy family be the only one wey dey turn Olubadan. Dem even join State government sef for the mata. 

Dem Lawyer even talk say the Olubadan and the Balogun family don disobey court as dem don put pipu for all the position wey bin dey open, position like dat of Ekerin, Asipa, Otun and Osinachi. Adediran, wey be dem Lawyer come dey beg court make he cancel all the appointment we dem do. But Sha O,  the Chief Judge for Oyo State, Justice Abimbola, say he no go answer dem O,  say make dem go carry court paper give everybody wey him name dey for the Mata,  but Sha O he say dem fit go carry the court paper put for wall for the office of Olubadan-in-Council. Court come push the Mata to March 8.

No comments: