One Federal High Court wey dey siddon for Lagos, yesterday, don warn we Federal Government and Distribution Companies, DISCOs, say make dem no disobey wetin court yarn in top electricity money. Tori yarn us say Trade Union Congress plus dem Padis dem carry different pali for the court area yesterday dey do Aluta say dem no gree make dem increase the electricity money. The judge on top the mata, Justice Mohammed Idris, for the court yesterday warn government say make dem no try disobey we rule of law O, COS na rule of Law get level pass anybody under democracy
He come say make all of dem go dey as dem be O, because dem gats treat plenty mats wey dey ground before dem touch the main mata cos na so dem talk before NERC go increase the electric money and upon do do, the light mata no improve. So make dem settle those mata wey include how dem go take punish NERC for say dem no first obey court command.

No comments:
Post a Comment