Monday, February 15, 2016

SHUU... NAIJA POLICE SCATTER GAY MARRIAGE FOR ABUJA



Naija Police for Abuja don scatter one gay wedding last Saturday for one kain hotel wey dey Jiwa for Abuja, King’s Land Hotel. The Police megaphone for Abuja,  ASP Anjuguri Manzah, say na gist dem hear O,  and na so dem sharperly enter the place go scatter dem.




Manzah say the gonfabis name na Ibrahim Lawal (husband) plus Umar Tahir (wife), and say 2 of dem na from Kaduna State.He say police still dey shine light on top the mata and dem go carry dem go court plus other pipu wey get hand for the yeye wedding. Because Police follow arrest pipu wey dey sponsor the wedding, plus persin wey get the hotel wey dem dey use. Make we no forget say na 2013, we former Presido Goodluck Jonathan carry the law nack for Naija.

No comments: