Monday, May 16, 2016

ON TOP WETIN? POLICE WAN START SCHOOL PETROL FOR LASGIDI

Oga patapata of Police for Lagos State, Fatai Owoseni, don yarn news men for one town hall meeting wey he do with pipu wey get mouth for Amuwo Odofin Local Government Area say police for Lagos State don ready to put beta security for schools wey dey the state. He say na patrol dem go take do am, na so he yarn when he dey This will be done by way of patrols. Oga Fatai Owoseni,
talk those things to some school children. Tori yarn us say Owolabi do the meeting after he collect command from him Oga, the Inspector General of Police, Solomon Arase, say make State Police Commands try rob body with dem community, so dem go fit do beta police work. Owoseni say na to make sure say school children dey safe and nothing do dem, make dem reason dat patrol level. He say schools wey dey for lungu, for dey very easy for dem badt guys like gbomo gbomo. He some still advice school children make dem dey shine dem eyes wella.

No comments: