Police for Enugu catch 2 undergraduates on Sunday say na dem kpain one StellaUhuo.
Na News Agency for Naija report say Police for Enugu, Mr. Ebere Amaraizu na him talk am for one statement wey him throway for Enugu. He said the badt guys wey dem no gree mention dem names na him police catch for Ebonyi and Kogi states. He say the 2 of dem kpain Uhuo, who be Yankee returnee after dem don collect all he property from her hand.
Tori yarn us say na the woman Halla one of dem on 14th November 2015, make he meet am for Enugu Airport come help her carry her load go Abakiliki. Na so the gonfabis drive Volvo go airport with him friend, dem put some load for one car and some for dem Volvo, Na for road dem kilobits the woman property and dem beat am die when she no dey cooperate come throway her dead body for Enugu-
Abakiliki Expressway carry her load run. Pipu wicked O

No comments:
Post a Comment