Monday, February 29, 2016

SEE MIRACLE... IHEANACHO SIDDON FOR BENCH COLLECT TROPHY WITH MAN CITY

Our beta pikin for England,  Kelechi Iheanacho don win the first trophy of him life for Manchester City for dem English League Cup wey dem win on Sunday. Na 3-1 dem flog Liverpool for penalty after dem nobfit score pass 1-1 for the match plus extratime for the match wey dem play for no Wembley. E good make persin get beta team o,  cos our guy bin dey bench sha and dem coach no use am at all,  Iheanacho, though pipu wey he carry enter na Pablo Zabaleta, Wilfried Bony and Jesus Navas. But for dat competition our guy bin score wen him team flog Crystal Palace 5-1 and when dem flog and Hull City 4-1for the fifth round.

No comments: