Monday, February 29, 2016

SEE GBEGE O, SERIKI WANT MAKE COURT PUT NEW OLUBADAN FOR PRISON

You say on top wetin?  Na on top say he wan become Olubadan o. As per say the former Olubadan don go join him Papa for yonder, na him Olubadan-in-council don talk say na 4th of March,  dis coming Friday dem go put crown for Baba Chief Salihu Adetunji head make he become the new Olubadan. But sha o,  dem Seriki family dey talk say court bin don talk say make dem no try dat kain thing since 2008, dat na why dem don go court say make court put Adetunji for court if dem mistakenly put crown for him head dis coming friday. Tori yarn say the New Olubadan, Baba Salihu never get time for dat kain thing now, and he go yarn wen the time reach. THE Baba of dem Seriki family, Chief Oyediji still dey clear dem say na him suppose be the new king cos na wetin dem agreement yarn data year be dat. Toor.....wetin go come happen o? Make we siddon dey look.

No comments: