Even as dem dey bomb reach for Naija, we presido don yarn on Sunday say Boko Haram no be headache again for us, we don fall dem hand. Presido say Boko Boys no fit disturb dem development plans again, although Sai Baba gree say dem bin don do us strong thing for Naija before but since him climb throne for Naija, Boko boys don dey suffer. Tori yarn us say him Special Adviser on Media and Publicity, Mr. Femi Adesina, na him yarn us say na wetin presido yarn be dat when he do meeting with the Emir of the State of Qatar, Sheikh Tamim Bin Hammad Al-Thani, on Sunday. So make all of una calm down o!
No comments:
Post a Comment