House of Reps don push dem plan to buy 360 big cars for dem 360 members. Tori yarn us say no be bcos dem like us o, na bcos say cash no dey dem hand, na him make say dem neva arrange the cars wey dem talk say na for committee waka. Dem plan be say na from budget money dem go buy am but as dem still dey gbege the budget for Senate, dem neva sabi wen dem go pass am. Na when dem pass am, dem go sabi how much dem go fit take buy the cars. E don tey sha when dem don dey get headache on top which kain car dem wan buy, some dey say make dem buy Peugeot 508 and some dey say na 2015 carmry go make sense pass.
No comments:
Post a Comment