One fine boy like dat, wey dey make brains for many plenty things like graphics design, dey do cinematography come still dey model join, don vex. Adeyemi Adeleke wey many pipu sabi as Mofti-Pro na one of the few male models wey dey make sense for Naija, especially for Ibadan wey be him kabaa.
Him face for inside beta cloth just full everywhere for Ibadan. So I just see say the Bros don vex enter music, although he don try small but I bin dey think say na play play, until I see this new one wey he call No Time. The song wey Finni Beat produce plus the art work wey he design for himself I too sure din dey get many pipu talking say e be like say Mofti ti take over. If na you nko, as per say "No Time". Na the link to download the song be dis.
http://wp.me/p3Xd9C-4aF
Pipu wey never hear the song don dey fall in love with Mofti-Pro from him art work design, especially babes dem.

No comments:
Post a Comment