Saturday, February 27, 2016

FINALLY DEM DON BURY LOWO WEY DEM SAY HIM LAWYER WIFE KPAIN FOR IBADAN

Make God sha be with him family,  COS no be better thing make parent see him pikin die. But tori wey reach our hand say no be small Mata yesterday wey be Friday 26th February, where dem bury Oyelowo Oyediran Ajanaku the guy wey dem talk say na him wife kpain am for dem house wey dey Akobo,  Ibadan on the 2nd of February, 2016. The burial we hear say happen for St' Paul's Cathedral Church of Nigeria (Anglican Comminion),  Oke Osun Diocese, wey dey GbĂ©nga for Osun State. Tori yarn us say Lowo padis dem from Yankee dem plenty well wey show face and all of dem tear body cry O, as per say dem guy don go forever. Meanwhile him wife wey dem talk say kpain am still dey court.

No comments: