Tuesday, November 24, 2015
KING COKES FOR SCREAM AWARDS DEY CELEBRATE HIM MAMA 68TH BYDAY TODAY
Lil Cokes na him e dey answer before but now he don graduate go King Cokes. The Legelege can destroy Rapper na him be the main man wey dey make Screams Awards happen. Na so he climb on top Instagram today, to carry love baff him Mama wey dey celebrate her 68th byday today. King Cokes describe him Mama as him life and him pillar, he even take style clear us say him na Janded. When he say the Mama don dey there for am since day 1 when he drop for South East London. He still let us know how he don turn him Mama to Microfinance Bank dey borrow money from her for different project. That na why he dey celebrate him Mama. So we sef for TPN celebrate you Mama King Cokes, Long life plus prosperity.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment