Sunday, February 14, 2016

NA WA O, PRESIDENT BUHARI DON COLLECT WORK FROM 13 VICE CHANCELLOR HAND

This one no be say dem say, Tori yarn us say we presido don yarn 13 Vice chancellors for 13 different Universities say make dem dey go house patapata, wetin dem do, dem say nobody sabi. Even dem shock pass electric wen dem hear say Presido don say make dem run commot from dem office. 


But we sha hear say Civil Society Organizations don carry the mata put for head like contract say he no make brain make Presido just wake up decide that kain thing. maybe Baba go change him mind abi he no go gree, make we siddon dey look.

No comments: