![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjvSm5GkztpfoLTNTr9tJJoQ0S0GWD4ylS7IFpNg9-NgW9D67AIgZQJ7ORpKMaHuQxxFFdBRxej7kD6Ai6cArRhdB1nrEDFzsiysQh-UQY0ONONq5l38a48iUBMsqKrZ8WZGxsR09T2Zqk/s1600-r/HEADER.jpg)
Wednesday, October 21, 2015
TOMMY TUSH WITH HIM HEMEDY MUSIC DEY ARRANGE MUSIC AND ENTERTAINMENT MUSIC INDUSTRY CONFERENCE
If you be musician abi you be entertainer, abi you dey believe say you fit do something for music industry, den you suppose attend the conference wey Tommy Tush dey arrange. According to wetin the bros yarn on top him facebook, na on Saturday the 31st of october the mata go shele for Upper Conference Hall, Alumni Center for UI, time go be 9am to 12pm and na plenty plenty things dem go teach pipu wey attend. If you wan attend he say make you sharperly sharperly send your name plus phone number to hemedymusic@gmail.com make you take book your seat. No say I no tell you o.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment