Naija don vex o. After DR Congo flog us 2-0 for Thursday, na him dey make we guys vex go wound Cameroon 3-0. As i no fit watch the match, na hear I come hear say for 39th minute na him Efe Ambrose shake dem net, 61st minute like dis Moses Simon dash dem anoda one den finally Odion Igalo tell dem make dem bone dat levelz with anoda goal for 88 minutes, just 2 minutes before dem save dem from we hand. As we don wake up so...make all the countries run go hide o.

No comments:
Post a Comment