Popular Ibadan Comedian wey still be game business man join, Professor Apple don welcome baby number 2 with him wife wey dem marry legally December last year. Na Tuesday October 6 the tear rubber baby boy land for the dommot of the black man and over happiness dey worry Prof. Apple and him wife cos dem say na Godwin. Na Tuesday we dey go chop naming ceremony now, ho sabi wetin dem go call dis new baby cos wen he born him first pikin na Goodluck Jonathan dey reign, so he name him pikin Goodluck, dis one wey Buhari come dey make we see maybe na Buhari he go call him new baby. So from TPN we say congratulobia to Professor Apple.

No comments:
Post a Comment