The mata be like plan work o, cos the Pastor no wan gree at all o, he no too tey wey he enter we backyard o but he don bombard the city no be small. Pastor Dexter Alamu and him wife wey get dat beta TV station for cable wey dem dey call Kingdom Africa enter Ibadan and since den levels for the city don change. Na programme on top programme dem dey do, and na so so big big gospel musicians dem dey carry near body for dem programmes. Since dem come dem don Marriagematics, African Praise wey dem take launch dem ministry Empowerment House and next week na Casual Sunday again. Ibadan una never see anything o. We just dey blow for every corner.

No comments:
Post a Comment